25 Na so too shuku-shuku go kover all di tins wey dem plant for di hill and nobody go fit go der again. E go bi where melu and sheep for dey go chop grass.”
Dem go abandon Siria town forever and animals go dey go chop grass for der and nobody go ever drive dem.
Plenty sheep and oda animals go kom chop grass for di towns wey God don skata.
Dem go dey waka for di valley and for di holes wey dey di rock. Yes, dem go kover evry shuku-shuku, bush and grass for di land.
Pipol go dey go use dia bow and arrows take katch animals for der. Yes, shuku-shuku go full evriwhere.
Just as melu sturbon, na so Israel pipol bi. So, how I go fit take feed dem like lamb wey dey for open field?
Filistia town go turn to wildaness where animals dey stay and chop grass.