Den Profet Isaya tell King Hezekaya sey, “Dis na sign of wetin dey happen. For dis year and next year, na food wey grow on en own, una go chop, but di year wey go follow dat one, una go plant and chop una food. Na so too una go plant vine and chop di grape.
Na so too shuku-shuku go kover all di tins wey dem plant for di hill and nobody go fit go der again. E go bi where melu and sheep for dey go chop grass.”