Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 7:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Wen King Ahaz wey bi Jotam pikin and Uzzaya grand-pikin dey rule for Judah, King Rezin for Siria and King Pekah wey bi Remalaya pikin for Israel, mash go Jerusalem go fight am, but dem nor fit win.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 7:1
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

En offisa Pekah wey bi Remalaya pikin plan against am. En and fifty men from Gilead kon kill King Pekahaya, Argob and Arieh for Samaria. Dem kill dem for di place wey dem dey guide pass for di palis. Pekah kon take-ova as king.


For fifty-two years wey King Zabud dey rule Judah, Remalaya pikin, Pekah kon bi king for Israel.


For dat time, God kon make King Rezin for Siria and Remalaya pikin, Pekah attack Judah.


For seventeen years wey Remalaya pikin, Pekah dey rule, Jotam pikin, Ahaz kon bi king for Judah.


For dat time, King Rezin for Siria and Remalaya pikin, King Pekah for Israel kon attack Jerusalem. Dem fight King Ahaz, but dem nor fit konker am.


Na for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya bi king for Judah, naim God take show dis message to Isaya, Amos pikin, about Judah and Jerusalem pipol.


“Bikos dis pipol rijet Shiloah kwayet wota wey dey flow pass, but dey fear wons dem si Rezin and Pekah,


So God kon make dia enemies attack dem. E make dia enemy vex attack dem.


Aram pipol dey buy una goods. Dem give una emeralds, purpol klot, fine tins and linen, koral and rubis, so dat una go give dem some of una goods.


Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.


Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ