Dis na di message wey e send dem: “Today na trobol day, bikos dem don ponish and disgrace us well-well. Wi bi like woman wey won born, but wi too weak to even push.
“Wimen wey neva born pikin before, naw, make una sing and shaut with happiness, bikos di shidren wey una go born, go plenty pass di ones wey di woman wey get husband, born.
Wen woman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en time to born don rish, but wen e don born, e go happy and e nor go remember di pain again, bikos e go si sey e don born pikin.