Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 66:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Wiked pipol dey do tins for God like sey dem dey do am give juju and dis kind tin dey make God vex for dem. Weda dem kill melu as sakrifice, dem go dey guilty like sey dem kill human being. Even if dem sakrifice lamb, e go bi like sey na dog dem sakrifice; even if na rice dem present, dem go dey guilty like sey dem offa pig blood as ofrin; or if dem offa incense give God, dem go still dey guilty like who offa am give juju, bikos dis pipol don choose dia own way and dem like di yeye tins wey dem dey do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 66:3
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.


Dem nor tink or rizin sef sey, ‘I dey burn some of di wood take bake bread and roast meat chop. Yet, I dey use dis same wood make juju and woship am?’


All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.


I bin dey vex for dem bikos of dia sin and long-trot, so I kon ponish and abandon dem bikos dem sturbon and dey do as dem like.


una go die yeye deat, bikos na so una wont am and una nor ansa wen I koll una or listin wen I tok to una. Una nor gri obey mi, instead una kon dey do wiked tins.


I always dey ready to welkom my pipol wey dey sturbon, dey do wrong and dey go dia own way.


God sey, “Di end don rish for doz wey dey keep diasef holy bikos of dia juju; doz wey dey go woship for juju gardin; wey dey chop pig and rat with oda yeye food.


Dia gift wey dem dey bring from Sheba or di incense wey dem bring from far land nor mean anytin to mi. I nor go fit asept dia ofrin again and dia sakrifice nor fit make belle sweet mi.’


kon take am go give Aaron sons wey bi priest. Di priest go pak di flower, oil and all di incense full en hand kon burn am for di altar as part of di ofrin wey dem give God. God like dis food ofrin smell well-well.


Den Haggai sey, “God sey na di same tin go happen to di pipol for dis nashon and evritin wey dem plant. So evritin wey dem offa for di altar, don dirty.”


Make una nor chop pig. E get strong leg wey divide, but e nor dey shew, so e nor dey klean. Make una nor chop dis animals or even tosh dia dead body.


Wen una dey bring una vow ofrin, make una nor bring any ashawo pesin ofrin kon give di Oga una God, weda na man or woman, bikos dat kind tin dey make di Oga una God vex.


Make una go kry give di gods wey una don choose, so dat dem go kom save una wen una dey trobol.”


For dat time, Israel nor get king; so evribody dey do wetin dem tink sey dey good for dia eye.


Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ