Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
For dat day, God go use en great and pawaful swod take ponish and distroy Leviatan; dat dragon wey dey twist and waka fast-fast. Yes! God go kill di great monsta wey dey inside sea.
“Dem go kill Assyria pipol with swod for war and nor bi swod wey human being make. Assyria pipol go run from di swod and dem go turn dia yong men to slaves.
una go die yeye deat, bikos na so una wont am and una nor ansa wen I koll una or listin wen I tok to una. Una nor gri obey mi, instead una kon dey do wiked tins.
Di nois go loud rish evriwhere for di eart. Bikos God get wetin E one tok against di nashon. E go judge evribody kon kill wiked pipol. Mi, wey bi God, don tok.”
For dat day, di pipol wey God kill, dia body go skata for difren part for di world. Nobody go mourn for dem and nobody go karry dem go beri. Dem go dey groun like manure wey dem gada.
Yu dey find betta tins for yorsef? Make yu nor worry yorsef, bikos I won bring wahala kom dis world. But anywhere wey yu won go, I go let yu go and I go save yu.’ ”
As yu dey buy and sell, na so too yu dey do bad tins and naw, where una for dey woship God, nor dey klean again. So, I vex set fire for di town kon burn am rish groun. Evribody don si sey yu don turn to ashes.
“Na yu I dey tok about before wen I tell my savant wey bi Israel profet sey, ‘For dat day, I go ask somebody make e attack Israel. God wey get pawa don tok.’ ”
God kon show mi anoda strong vishon. For dis vishon, I si as E dey ready to ponish en pipol with fire. Di fire burn di big sea, den e kon start to burn di land.
But know matter wetin una do, fire go still kill una; una enemies go kill una like lokust. Dem go kill evritin wey dem si and una nor go fit eskape, even if una plenty like many lokust.
Dem dey ready to kill. Dia swod and spear dey shine as dem dey kill pipol for evriwhere. Nobody fit kount di pipol wey dem kill and doz wey remain dey run fall on-top di dead body dem.
Una go from dis valley go di mountin kon eskape go di oda side. Una go run, just as una grand-grand papa dem do wen groun open for di time wen Uzzaya bi king for Judah. Den all di angels go follow Oga God wen E dey kom.