So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.
I go sorry for Jerusalem and evribody wey dey stay di land wey dem skata. Even doh en land na desert, I go turn am to gardin and e go bi like Eden gardin. Joy and happiness go dey der and dem go sing songs take praiz and tank mi.
“So make una happy with Jerusalem; all of una wey like dis town, make una happy for am! All of una wey bin dey mourn for am, make una happy with am naw!