10 “So make una happy with Jerusalem; all of una wey like dis town, make una happy for am! All of una wey bin dey mourn for am, make una happy with am naw!
Wen all dis tins dey happen, pipol go sey, “Look! Make una si God for here! Wi wait for am and E don kom diliver us. Si God for here! Wi really wait for am. So make wi rijoice and dey happy bikos E don save us.”
Di desert go sing and shaut bikos e dey happy; e go fine like Lebanon mountins. Di soil go dey good like Sharon and Karmel farms. Evribody go si God glory, en greatness and pawa.
Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.
I go sorry for Jerusalem and evribody wey dey stay di land wey dem skata. Even doh en land na desert, I go turn am to gardin and e go bi like Eden gardin. Joy and happiness go dey der and dem go sing songs take praiz and tank mi.
Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.
“Make yu pass thru evriwhere for Jerusalem kon mark di pipol front head; pipol wey dey face trobol and wahala, bikos of all di bad tins wey dey happen for di town.”