Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 65:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 I go bless Israel pipol wey kom from Judah tribe and na dia shidren-shidren go stay my land. My pipol wey I choose wey serve mi, na dem go stay for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 65:9
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Time dey kom wen Jakob shidren-shidren go get rut like tree and dem go grow well. Di fruit wey dem go bear, go full di eart.


Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help.


God pipol nor go worry again; peace go dey dia house and dem go dey save.


I nor dey tok for sekret or for di dark place for di eart. I neva ever sey, ‘Jakob shidren just dey follow mi for nor-tin.’ Mi wey bi God dey tok di trut. Yes! I dey tok wetin dey rite.”


Dem go bless and praiz Israel pipol, bikos of di Oga awa God.”


God tell en pipol sey, “Wen di time don rish to save una, I go favor and ansa una wen una kry for help. I go guide and protet una kon make kovenant with evribody thru una. Una land wey skata and wey dirty bin full, I go klean am kon make una stay der again.


Wen una kry for help, make una juju kom save una. Na one small breeze go karry dem go! But pipol wey trust mi go stay di land kon woship mi for my temple forever.”


Una pipol go do di rite tin and dem go get di land forever. Na mi plant and make una, so dat evribody go know how I great rish.


Di pipol wey I choose go use una name as curse. Mi, God wey bi king, go kill una. But I go give new name to pipol wey obey mi.


Anoda pesin nor go stay inside di house wey dem build and odas wey nor plant, nor go drink di wine wey my pipol make, bikos my pipol go get long life like tree and dem go enjoy evritin wey dem work for.


From evry tribe, kountries or towns wey una dey, I go bring una kom back to una house.


For dat time, I go gada and bring una kom back to una house. Wen I dey give una evritin wey una don lost before, I go make evribody for dis world respet and honor una.” Mi, Oga God, don tok.


And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.


As e bi sey Jew pipol rijet God word, dem don turn to God enemy, bikos of una wey bi Gentile pipol. But as God wont am, dem bi pipol wey E love, bikos of dia grand-grand papa dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ