17 God sey, “I go kreate new heavens and new eart. Nobody go remember di tins wey don happen before and e go komot from dia mind kpata-kpata.
But God sey, “Make una nor tink about wetin dey happen or put una mind for wetin don happen before.
Make una remember wetin happen before-before! Na mi bi God and e nor get any oda god. Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi.
I stresh heaven kon make di eart foundashon! I tell Jerusalem, ‘Una bi my pipol! I don tish and protet una with my hand.’ ”
God sey, “Just as di new eart and heaven wey I go make go dey with mi forever, na so too una name and una shidren-shidren name go dey with mi forever.
For dat time, una go plenty well-well for di land and pipol nor go sey dem wont Oga God Kovenant Box. Dem nor go even tink or remember am again: dem nor go miss am, tok-less of to make anoda one.
But God word sey, “No eye don ever si; no ear don hear, even pesin mind nor fit tink about di tins wey God don prepare for pipol wey love am.”
So, if any man dey inside Christ, e don dey new, Christ don klean di bad tins wey e do before and evritin don turn to new one!
Dis mean sey di tins for eart go shake komot and na only di tins wey God nor won shake, go remain.
But as God promise, wi dey wait for di new heaven and eart, di place where raitiousness dey.