Wen una si sey dis tins dey happen, una heart go happy and una go prosper like grass. Den una go know sey, ‘Mi wey bi God dey help pipol wey obey mi, but I dey vex for my enemies.’ ”
Yu don make di pipol plenty kon give dem great joy. Dem dey happy for yor present, just as doz wey dey harvest wetin dem plant dey happy or as sojas dey celebrate wen dem divide wetin dem karry kom from war.
God even sey, “Make una sing and happy for Israel pipol; make una happy for di nashon wey great well-well. Make dem hear una praiz for evriwhere kon sey, ‘God, make Yu save yor pipol, diliver Israel pipol wey remain.’