I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.
God sey, “Di day dey kom wen korn go kwik grow even before harvest time rish and grape go grow kon ripe before dem suppose make wine. Sweet wine go dey rush kom out from di mountins and wine go dey flow for di hills.
For dat time, E go stand on-top Mount Olives kon face di east side for Jerusalem. Den Mount Olives go divide into two from east go west. Half part for di mountin go-go nort and di remainin part go-go sout.