So Jehu orda, “Make una trow dat woman kom down!” So dem trow Jezebel from di window kom down. And as Jezebel nak groun, en blood kon spread go di wall and di horse body, den Jehu ride en horse pass Jezebel dead body.
But awa Oga God wey dey lead heaven sojas get di day wen E go kause wahala and konfushon for Vishon Valley and evribody go beg make di mountins kom help dem.
E go wear good judgement for body like war koat kon wear viktory like priest kap for en head. E go wear klot wey go make am do good tins kon ponish doz wey dey sofa pipol.
Dem wiked well-well and just as dem dey kut korn for harvest time, na so too I go kut dem trowey kon mash dem, just as dem dey mash grapes until di wine kom out finish.
Den my enemies go si sey God dey for my side and shame go katch dem. Dis na di same enemies wey ask sey, “Where dat yor Oga God dey?” And naw, I go si as dem dey fall and I go mash dem pass like portor-portor for road.