Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 63:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Just as dem dey lead melu go valley wey get betta grass, na so too God dey give en pipol rest. E lead en pipol kon bring honor to en name.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 63:14
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

No kountry for dis world bi like Israel wey Yu komot from slave kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt, plus di juju and gods wey dey der.


Awa God, wi tank and praiz yor name wey get pawa.


Levi pipol: Jeshua, Kadmiel, Bani, Hashabneaya, Sherebaya, Hodaya, Shebanaya and Petahaya kon tell di pipol sey, “Make una stand praiz di Oga una God bikos E dey forever and ever!” Den dem pray sey, “Wi go praiz yor holy name! Make yor name high pass evry blessing and praiz!


Cypress trees go grow for where grass dey naw. Myrtle trees go grow for where shuku-shuku dey. Dis sign go dey forever and e go dey remind una about wetin mi wey bi God don do.”


Where God wey do great tins thru Moses wey divide di sea kon lead en pipol pass di deep wota, so dat honor and glory wey nor dey end, go bi en own?”


Yu do strong and wonderful tins for Egypt and Yu still dey do dem till naw, both for Israel and for all di nashon and naw, dem don know Yu for evriwhere.


My Spirit still dey with una, just as I promise wen una dey kom out from Egypt, so make una nor fear.


Just as God kommand, dem go stay for one place or travel, bikos dem dey obey di words wey God kommand Moses.


“Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.”


so dat wi wey first bilive Christ, go dey gi-am praiz and glory.


So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.


Na God dey guide dem by ensef, e nor get any oda god wey dey with am.


God dey protet dem, bikos of di promise wey E make with dia grand-grand papa. E nor get any enemy wey fit fight dem.


Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east.


E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ