8 God don make betta promise and E go make am happen with en pawa den E go sey: “Enemies nor go chop una korn again and strenjas nor go drink una wine again.
“I promise una for Noah time sey I nor go use wota distroy di world again. Naw, I dey promise sey I nor go vex for una again and I nor go rebuke or ponish una again.
Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.
Dem go chop evritin wey una plant and una animals too; dem nor go leave one fruit for una vine tree. Even doh una tink sey una dey save inside una strong town, dem go distroy di town kon kill una shidren.
Tell dem wetin I dey tok. Wen I choose Israel, I promise Jakob shidren-shidren kon show mysef and tell dem wen dem dey Egypt sey: ‘Na mi bi di Oga wey bi dia God.’
I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant.
I go bring my pipol kom back to dia land. Dem go ribuild dia towns wey skata kon stay der again; dem go plant vine kon drink di wine; dem go plant food for dia farm kon chop wetin dem plant.
Di woman wey una dey won marry, anoda man go rape am. Una go build house, but una nor go fit stay inside. Una go plant vineyard, but una nor go chop dia fruit.
Dem go kill una melu for una own eye, but una nor go chop for inside. Dem go tif una donkey for una eye and dem nor go bring dem kom back. Dem go give all una sheep to una enemies and nobody go dey to save una.