3 For God hand, una go bi like crown wey get glory! Yes, una go bi like royal crown for God hand.
I go karry dem without shame for my shoulder kon wear dem like king crown.
For dat time, God wey get pawa go bi betta crown wey get glory to en pipol wey survive.
Wen dat day rish, just as shepad dey save en animals from danger, na so too Oga God go save en pipol. Dem go shine for en land like crown wey dem make with gold.
“Na only God get Glory for heaven and eart, make peace and favor dey with evribody.”
Nor bi una bi awa hope, joy and crown wey wi go take boast give Jesus wen E kom? Yes! Na una!