Di profit wey dem go make, dem go gi-am to God. Dem nor go keep di money or allow am many for one place, but dem go give di profit to pipol wey always dey stay God present and dis pipol go use am take buy enough food and fine-fine klot wey dem go wear.
God dey tell di strenjas wey join en pipol, doz wey love and dey serve am well; wey dey keep di Sabat Day and dey faithful as dem dey keep en kovenant sey:
God sey, “I go make una prosper forever; all di nashon propaty go kom meet una like river wey nor dey dry. Una go bi like pikin wey en mama kare and karry for hand kon trit am with love.
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
Na Christ savants bi? (I don dey tok like sey I dey kraze again!) Misef na Christ savant wey betta pass dem! I don work hard pass dem, I don dey prison plenty times pass dem, dem don beat mi well-well pass dem, I don nearly die plenty times.
So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.
God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.