Even doh wi bi slave before, Yu nor leave us as slave. Yu make Persia king favor us kon allow us go ribuild yor temple wey skata and make wi wey dey Judah and Jerusalem get peace.
Una pipol go build wetin don skata since, dem go build am put for di old foundashon again. Dem go know una as pipol wey ribuild di wall and house wey dem bin skata.”