19 Di sun nor go bi una lite for day time again or di moon for nite, bikos na mi, wey bi God, go bi una lite forever and my glory lite go always dey shine on una.
Di moon go dey dark and sun nor go shine again, bikos Oga God wey dey lead heaven sojas, go rule from Mount Zion for Jerusalem and evribody go si en glory wey big well-well.
Full moon lite go shine like sun for aftanoon and sun lite go shine seven times pass as e dey shine before and e go bi like seven days lite. Den God go join en pipol bones wey bin break kon heal all dia wound.
God sey, “I go ponish dem well-well and na dia own slave go distroy and pak dia propaty.” Den una go know sey na Oga God wey dey rule ova evritin send mi kom.