16 Nashons and kings go kare for una as mama dey kare for en pikin. Den, una go know sey, mi wey bi God, don save una. Israel God wey get pawa don free una.
I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.
Wen all dis tins dey happen, pipol go sey, “Look! Make una si God for here! Wi wait for am and E don kom diliver us. Si God for here! Wi really wait for am. So make wi rijoice and dey happy bikos E don save us.”
So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”
Instead of bronze, I go give una gold. I go give una silva and bronze, instead of iron and wood; den I go still give una iron, instead of stone. Una rulers nor go opress una again and I go make dem rule with betta judgement and peace.
Wen una si sey dis tins dey happen, una heart go happy and una go prosper like grass. Den una go know sey, ‘Mi wey bi God dey help pipol wey obey mi, but I dey vex for my enemies.’ ”