9 So E tell mi make I go give di pipol dis message: “E nor get as una go listin rish, una nor go undastand. E nor get as una go look rish, una nor go know wetin dey happen.”
So God word nor make sense at-all to dem and na dis go make dem fall wen dem try to waka. Yes! Dem go fall for trap kon wound and dia enemies go karry dem go as prisonas.
God don make una dey do like sey una don drink, so una go sleep go. God don blind di profets eyes and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.
God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
So I go still do tins wey go dey sopraiz dem: tins wey dem nor go undastand. Wise men nor go get anytin to tok; doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”
so dat, “dem go dey look, but dem nor go si, dem go dey hear, but dem nor go undastand and dem nor go fit turn from dia sin kom meet God make E forgive dem.”
Jesus ansa dem, “Una get di shance to know God Kingdom sekret, but dis oda pipol, na only parabol dem go take hear am, so dat “As dem dey look, dem nor go si and as dem hear, dem nor go undastand.
“God don blind dia eye and make dia heart strong like stone, so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart, so dem nor go fit kom meet mi, make I for heal dem.”