Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 6:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Even if na one pesin for evry ten pipol remain for di land, dem go distroy am, e go bi like oak tree or Asherah pole wey dem kut for groun or sometin wey dey holy wey dem distroy. Dis holy tin, na di special family wey God choose.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 6:13
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos yu don obey mi, evribody go get blessing, bikos I go bless yor shidren-shidren.’ ”


Jew men dey marry wimen wey bi strenjas, so dem don dirty God pipol wey dey holy and na di leaders and ofisas dey do dis tins pass.


“But naw, for dis short time, awa Oga God, Yu don trit us well kon stop some of us to bi slave and wi dey live for peace for dis Holy Place. Yu don remove us from slave work kon give us new life.


If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive, dem for don distroy Jerusalem finish, like Sodom and Gomorrah.


For dat time, one pesin go kom from Jesse family. Yes! One rut go grow kom out from David house.


Den doz wey God save wey go remain for Jerusalem, pipol go koll dem, “holy pipol.”


“I go let some of dem eskape di kilin, but I go skata dem go difren kountries


God wey get pawa sey, “One town for Israel send 1,000 sojas go fight, but na only hundred pipol kom back; anoda town send hundred, but na ten kom back.”


Dem go rule Assyria with dia swod kon enter Nimrod land. E go save us from Assyria pipol wen dem kom attack us.


Pipol wey dey honbol and good, na dem go stay with una and dem go dey save for God present.


and if dem divide all di pipol wey dey di land into three, two part go die finish.


God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.


And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.


If God nor kut doz days short, nobody go save. But bikos of di pipol wey God don choose, E don make doz days short.


Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.


Even doh una many like di stars for sky, na only some of una go remain, bikos una nor gri listin to God.


Bikos una dey holy and na di Oga una God bi una papa. From all di pipol wey dey di eart, di Oga una God don choose una to bi en own special pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ