God sey, “I go ponish my shidren wey nor dey obey my kommand. Pipol wey dey do wetin dem like and enter agriment with wiked pipol kon dey do tins without my Spirit. Dem just dey add join dia sins.
Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.
Just as well dey bring fresh wota kom out, na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out. I dey hear war and distroshon nois for di town kon si wound and sickness for evriwhere.
God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
But till naw, my pipol dey tok against mi like sey I bi dia enemy! Doz wey trust mi, una tif dia klot kon let dem look like pipol wey dey kom from war.
Oga God sey, “I hate divorce. I hate wen one pesin among una do dat kind wiked tin against en wife. Make una make sure sey, una nor break di promise wey sey una go always dey faithful to una wife.”