Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.
E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”
I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
“Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”
So God wey dey rule evritin kon sey, “Like iron, na so too I go melt and test my pipol for fire, bikos dem don do wiked tins well-well. Abi na how I won do dem pass?
So, as long as mi God wey get pawa bi di God wey nor dey die, una must die and una nor go fit eskape am. Just as una kill pipol, na so too dem go kill una.
God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
Dem nor dey keep di promise wey dem make. Instead, dem dey lie, kill, tif and sleep with oda pipol husband and wife. Na so-so wiked tins dem dey do and dem dey kill each oda evriday.
Dia own don finish! Dem don forget mi kon dey do wetin I sey make dem nor do, so I go distroy dem. I won save dem before, but dem nor dey woship mi from dia heart.
But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”
Betta pipol wey dey fear God, don die komot di eart and e nor get anybody wey dey good and honest for dis eart again. Evribody for di eart dey wait to kill each oda; dem dey set trap dey wait dia brodas for road.