Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
So tell dem sey: “Dis na nashon wey nor gri obey di Oga dia God or learn from dia wahala. Nobody for der dey good and di pipol nor dey even tok about good tins again.
“Wen ever I sey I won heal and make my pipol, Israel prosper again, dia wikedness and di bad-bad tins wey dem dey do, nor dey allow mi do am. Samaria pipol dey shit each oda and dey do bad tins. Dem dey break enter pipol house and dey tif waka for street.
Bikos of dis, di law dey weak and yuzles and doz wey dey judge, nor dey judge well at-all. Wiked men dey opress good pipol; dem don turn betta judgement up-side-down.