and nobody dey save around una. Evritin wey una dey do nor get betta judgement. Una dey follow di wrong road. And nobody wey dey pass dat road, dey save.
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
Dem don disgrace and karry Nineveh pipol go anoda land. Dem don drag dia kween go. En girls savant dey mourn for am; dem dey kry like dove kon dey nak dia chest.
Nineveh town full with pipol before, but naw, all di pipol don run komot. Even wen somebody shaut, “Make una stop! Make una nor run!” But nobody gri listin to am.