So God word nor make sense at-all to dem and na dis go make dem fall wen dem try to waka. Yes! Dem go fall for trap kon wound and dia enemies go karry dem go as prisonas.
Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.
So, na only darkness una go dey si and una nor go get any vishon. Darkness go kover una kon end evry hope wey una get. Sun nor go shine for una profets head again a nd una life go end like dat.
Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.
“God don blind dia eye and make dia heart strong like stone, so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart, so dem nor go fit kom meet mi, make I for heal dem.”
For aftanoon, una go dey find road to pass like blind pipol and doz wey dey darkness and una go dey fail for evritin wey una dey do. Pipol go always dey tif una tin and opress una and nobody go save una.