Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 58:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Wen una pray, I go ansa una. Wen una koll mi, I go hear una. If una stop to opress pipol and tok wiked words kon stop wiked tins;

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 58:9
31 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jakob go meet en papa kon sey, “My papa!” Isaak ansa, “Na mi bi dis. Wish of my pikin dey tok?”


Wen yu pray, E go ansa yu and yu go keep di promise wey yu don make.


Wen I dey trobol, I pray to God and E ansa kon free mi.


Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.


God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.


Naw, I know sey God dey save di king wey E anoint. E ansa di king from en heaven wey dey holy kon save am with en great pawa.


Make yu depend on God and E go give yu evritin wey yu wont.


Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”


Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.


Dem go use dia eyes take make sign kon use dia legs and fingers take deceive pipol.


Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.


Una go stay for Zion! Jerusalem pipol nor go kry again. Wen God hear as una dey kry with pain, E go kom save and help una. Yes! E go ansa wen una kry for help.


Make una turn and pray to God naw wen E dey near una.


Who una dey fool? Who una dey laf and lie give?


Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.


Make una nor tink sey God dey too weak to save una or dey deaf to hear wen una koll am for help!


Wi don fight, rijet and refuse to follow Yu. Wi opress odas kon turn from Yu. All wetin wi dey tok and tink, na lie dem bi.


Even before dem go pray to mi, I go ansa dia prayers and as dem still dey tok, I go hear dem.


Yes! Wen I koll Yu, Yu kom tell mi sey, ‘Nor fear.’


Den God kon tell mi: “Una words na lie and una vishons nor go happen. I really dey vex for una.


As I still dey pray, dey konfess and beg God make E forgive mi and Israel pipol sin kon sorry for en holy temple,


Di day wey e dey riton dem, e go pay di owner komplete money kon add twenty percent join am.


Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem.


I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ