Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 58:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Na di kind fasting wey I choose bi dis? Na only di time wey una dey fast una dey-dey honbol? Na just to skrape di hair for una head rish groun, I wont? Abi, na to just wear sak kon sleep for ashes? Na dis one una dey koll fasting, di day wey God wont?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 58:5
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di king hear wetin di woman tok, e tear en klot. As di king dey waka pass di town wall, di pipol kon si sey e wear sak klot.


Jehoshafat kon dey fear, so e go meet God. E kommand evribody for Judah sey make dem fast.


Den e get up from di temple front kon enter Jehohanan wey bi Eliashib pikin room. E dey der thru-out dat nite dey kry for di pipol sin. E nor chop or drink anytin.


For where wi dey for Ahava River, I kon orda sey make all of us fast and honbol awasef before God and make wi ask am make E lead and protet us, awa shidren, all awa propaty and for awa journey.


“Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”


And for evry aria where dem for read dis law, Jew pipol wey dey der, dey kry, fast, wear sak klot kon pak ashes for dia head.


Job sidan outside near dirty kon use breaki-breaki pot take dey skrape en sore.


So my God, make Yu hear my prayers kon favor mi and bikos of yor great love, make Yu ansa and diliver mi!


God tell en pipol sey, “Wen di time don rish to save una, I go favor and ansa una wen una kry for help. I go guide and protet una kon make kovenant with evribody thru una. Una land wey skata and wey dirty bin full, I go klean am kon make una stay der again.


Di pipol ask, “Wetin make us dey fast and honbol awasef if God nor go ansa us?” God kon tell dem, “Di true bi sey, for di time wey una dey fast, una still dey opress una workers and run follow tins wey una like.


E send mi kom tell pipol sey di time for God to save en pipol and defeat dia enemies, don rish! Yes, E go konfort doz wey dey mourn.


“Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work.


Dat day go dey very holy, dem go fast and dem nor go do any work at-all. Dem go keep dis law forever.


“Make yu ansa di pipol and di priests, ‘Since una dey fast for di fift and sevent mont for seventy years naw, una really dey do am bikos of mi?


“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.


and make I announce sey di time wen God won save en pipol, don rish.”


Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.


So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ