Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 58:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Una fasting dey make una wiked and una still dey kworel and fight. Una tink sey dis kind fasting go make mi listin to una prayers?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 58:4
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.


Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.


God won judge doz wey dey lead en pipol. E sey, “Na una skata di vineyard kon pak poor pipol tins full una house.


Why una dey wahala my pipol and sofa doz wey nor get money? Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


Na bikos of una sins make am nor dey hear una. Na una sins dey separate una from God wen una try to woship am.


But di evil nor go do una any good; dem dey yuzles like klot wey dem make with dirty!


Dis na wetin make God sey, “Make una turn from sin kom meet mi naw wey time still dey. Make una give mi una heart. Make una fast, kry and mourn as una dey kom meet mi.


E kon kommand, “For inside dis kingdom, Nineveh, mi and all my ofisas don gri sey: ‘Make nobody or animal, chop or drink anytin.


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


Dem dey sofa wimen wey dia husband don die and kollect dia tins kon dey pray long prayer make pipol for si dem. So na dia ponishment go big pass.”


Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ