Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 57:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Una take smooth stones from der kon dey woship am as god. Una pour wine put kon give dem rice as ofrin. So, una tink sey I dey happy with all dis tins wey una dey do?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 57:6
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But una wey nor dey obey mi; wey don forget my holy mountin. Wey prepare tabol for Gad wey bi Babilon god kon mix drink for dat god wey dem dey kol Destiny, wey dey give hope and luck to pipol,


Wiked pipol dey do tins for God like sey dem dey do am give juju and dis kind tin dey make God vex for dem. Weda dem kill melu as sakrifice, dem go dey guilty like sey dem kill human being. Even if dem sakrifice lamb, e go bi like sey na dog dem sakrifice; even if na rice dem present, dem go dey guilty like sey dem offa pig blood as ofrin; or if dem offa incense give God, dem go still dey guilty like who offa am give juju, bikos dis pipol don choose dia own way and dem like di yeye tins wey dem dey do.


Di house for Jerusalem; Judah king house and di pipol house wey dem for don burn incense give di stars kon pour wine as ofrin give oda gods, all of dem go dirty, just as Tofet dirty.” ’ ”


Bikos Israel sin nor mean anytin to dem, dem kon kontinue to spoil di land as dem dey woship stones and wood.


and burn am rish groun. Dem go burn am with di house where pipol for don make mi vex, bikos dem dey burn incense give Baal juju on-top di house and dey pour wine as ofrin give oda gods.


So, I go really ponish dem for evritin wey dem do. Yes! I go bring sorrow and pain kom dis nashon!”


Naw, God sey, ‘I go really ponish dem for evritin wey dem do. Yes! I go bring sorrow and pain kom dis nashon!’ ”


Dia shidren dey gada firewood; men dey make di fire and di wimen dey mix flower wey dem go take bake kake for dat juju wey dem dey koll, ‘Heaven Kween.’ Dem still dey pour wine give oda gods as ofrin and dis tin dey make mi vex.


Make I nor ponish dem for all dis tins wey dem do? Abi make I nor distroy nashon wey bi like dis?” Mi, wey bi God, don tok.


God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju.


Curse dey una head! Una dey tell ordinary wood and stone sey, ‘Make una wake-up kon save us!’ Juju go fit tell una anytin? Dem fit make am with silva and gold, but e nor get life at-all.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ