Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
“Pipol wey dey make juju nor mean anytin and di juju wey dem tink sey dey give dem happiness, nor mean anytin at-all. Di pipol wey dey serve di juju nor dey si and dem nor know anytin; so na shame and disgrace go follow dem.
Yu dey help pipol wey dey do wetin dey rite; pipol wey remember how Yu wont make dem dey live dia life. But wen wi kontinue to dey kommit sin, Yu vex for us. So na how wi wont make Yu take save us?
for dia sins and dia grand-grand papa own. Dem don burn incense for juju hills kon tok bad tins about mi. So I go ponish dem for wetin dem don do pass.”
All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.