My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.
God sey, “If una keep di Sabat Day holy and una nor run follow wetin una wont dat day; if una value my holy day and honor am and una nor travel, work or tok yeye word for dat day,
God sey, “If man drive en wife and di woman go marry anoda man, di man go fit go marry di woman again? Dat kind tin go make di land dirty. But Israel pipol, una bi ashawo wey get many husband and naw, una won turn back kom meet mi.
Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.
Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”