Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 54:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God sey, “My Jerusalem; di town wey dey sofa and nor get help; di place wey nor get who go konfort am. I go use stones wey dear well-well take build una foundashon again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 54:11
43 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just as Solomon tok, dem kon kut fine big stones wey dem go take build di temple foundashon.


I don try to prepare silva, gold, bronze, iron, timba, stones wey dear, jem stones to take make di floor and many marbols to take build di temple.


E dekorate di temple with precious stones and na from Parvaim dem from bring di gold wey e use.


Di gold and jewel wey fine pass nor get value rish wisdom.


Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well, but God go save dem from all dia wahala.


Afta sometaim, Egypt king kon die, but Israel pipol still dey kry, bikos dem dey sofa well-well. So dem kry well-well to God for heaven.


and dem si Israel God. Sometin wey bi like karpet wey dem take safaya stone make dey under en leg and e klear like sky.


Den God angel appear to am like fire for inside di bush. Wen Moses look, e si sey di fire dey katch, but di bush nor dey burn!


God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish.


En hand round like gold with beryl stone and en body bi like elefant horn wey dey shine like safaya stone.


How una go take ansa di messenjas wey dey kom meet una from Filistia land? True-true, God don make Zion great and en pipol wey dey sofa, go dey save for der.


Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’


Na mi tell Cyrus sey, ‘Na yu bi di pesin wey go rule; yu go do wetin I wont make yu do. Yu go orda make dem build Jerusalem again kon ribuild di Temple.’ ”


But Jerusalem pipol sey, “God don abandon us! Di Oga awa God don forget us.”


Jerusalem pipol wey dey sofa, una wey dey stagga like sey una don drink,


But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”


I go build una towa with rubi kon use stones wey dey shine like fire take build una gates. And di wall wey surround una, na jewels I go take build am again.


Israel pipol, una bi like yong wife wey sorrow full en heart, bikos en husband leave am.” But God dey koll una kom meet am sey,


Dem nor go hate and look down on una again. Una town wey dem skata and distroy, I go make am great and beautiful and joy go dey der forever and ever.


And even doh una enemies sey, ‘Zion nor mean anytin and nobody kare about am,’ I go make una well again kon heal una wound. Mi, wey bi God, don tok.”


Even doh dem hear sey I dey sofa, nobody gri kom konfort mi. My enemies know sey I dey trobol and dem dey happy to si as God ponish mi. Make di Judgement Day wey Yu promise kom, so dat dem go sofa, just as I don sofa so.


On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.


I look on-top di creatures wey dey alive kon si sometin wey bi like throne wey dem make with safaya.


For dat day, dem go ribuild Israel town and dia land go wide well-well.


At wons, strong breeze kon dey blow for di sea and wave won sink di boat. But Jesus Christ dey sleep.


“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”


Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”


Dis na bikos, God don build una on-top di apostles and profets foundashon and na Jesus Christ bi di nomba one stone wey God take lay di foundashon.


For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ