1 “Wimen wey neva born pikin before, naw, make una sing and shaut with happiness, bikos di shidren wey una go born, go plenty pass di ones wey di woman wey get husband, born.
Heavens, make una shaut dey happy! All di deep part for dis eart, make una shaut well-well! Make mountins and evry tree for di forest, shaut too, bikos God protet Israel pipol kon show how E great rish.
So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.
Una kountry skata and evribody bin run komot der, but naw, e go dey too small for una pipol. And doz wey leave una wen una dey face wahala, God go remove dem from una forever.
Dem nor go koll una “Pipol wey dem rijet again” or koll una land, “Di wife wey en husband drive komot house.” But dis na di new name wey dem go koll una, “God dey happy with una.” Dem go tell una land sey: “Yu marry well.” Dis na bikos God dey happy with una and E go bi like husband to una.
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
Bikos dem rite am sey: “Woman! Yu wey neva born, make yu shaut dey happy, bikos yu neva labor like woman wey won born. Di woman wey neva born, get plenty shidren pass di woman wey get husband.”
Pipol wey dey chop well and get evritin before, don dey fine work naw, so dat dem go si food chop, while doz wey dey hongry before, don si plenty food chop. Even di woman wey neva get belle before, don born seven shidren, but di ones wey get plenty shidren, nor get again.