9 Even doh e nor do any bad tin or tok lie, dem plan to put am for grave with wiked pipol but dem kon beri am for rish man grave.”
and dem beri am, den God raiz am up afta three days as dem rite for God word.
Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.
Dis awa High Priest undastand us wen wi dey weak, bikos all dis temptashon wey wi dey face so, e face dem too, but e nor sin.
Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven
and e nor kommit any sin or lie.
And una know sey God send Jesus kom, make e for karry sin komot and know sin dey inside Christ.