Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 53:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Dem trit and ponish am anyhow, but e put body down kon bear-am like lamb wey dem won go kill and e nor tok anytin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 53:7
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, I bi like deaf to dem. I nor dey ready to kworel or ansa dem back.


But I dey wait for Yu, my God. My Oga God, make Yu kom ansa mi.


Yet bikos of am, dem dey kill us evriday; dey trit us like sheep wey dem won kill.


I dey open my back to pipol wey dey beat mi. I nor dey stop dem wen dem dey curse mi; even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.


All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.


Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”


one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;


But Jesus kwayet. Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”


But Jesus kwayet and e nor ansa dem. Den di High Priest kon ask am again, “Na yu bi Christ wey bi God Pikin?”


But Jesus nor tok anytin and dis tin kon sopraiz Pilate well-well.


Herod kon ask Jesus many kweshon, but Jesus nor ansa am at-all.


Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”


So e enter di house back kon ask Jesus, “Na where yu from kom sef?” But Jesus nor ansa am.


Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha.


Den I si one Lamb wey bi like sey dem don kill-am, but e stand for di throne centre with di for creatures and di twenty-four eldas. E get seven horns and seven eyes wey bi God seven spirit, wey E send enter di eart.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ