But Moses ansa God, “If I go meet Israel pipol kon tell dem, ‘Na una grand-grand papa God send mi kom meet una.’ Den dem ask mi, ‘Wetin bi en name?’ Na wetin I go ansa dem?”
God ansa, “I go make all my goodness pass yor front and I go announce my name as Oga God to yu. I go show kindness to who I choose and I go show mesi to who I like show am to.”
So Jerusalem, make yu go on-top high mountin. Make yu prish di good news! Koll Zion pipol with loud vois, den announce di good news! Shaut as yu dey tok and nor fear at-all. Make yu tell Judah towns sey God dey kom!
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
Nashons and kings go kare for una as mama dey kare for en pikin. Den, una go know sey, mi wey bi God, don save una. Israel God wey get pawa don free una.
“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”