Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 52:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Jerusalem pipol, make una shake unasef kon dey free! Make una stand up from dirty kon sidan for una throne! Zion pipol, make una luz di shain wey tie una!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 52:2
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dat time rish, I go free una from Assyria pipol pawa and dem nor go bi load for una shoulder again. I go free una, bikos dia load go too dey heavy for una to karry.”


I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.


Jerusalem go fall and as dem dey groun dem go kry for help, but nobody go hear dia vois.


Den Zion pipol go sidan for groun dey kry and mourn, bikos of dia pipol wey die.


Den una go tell unasef sey, ‘Who give us all dis shidren? Wi know sey dem kill awa shidren kon karry di rest go as slave. Na only wi dey, so where all dis shidren from kom? Na who born dis shidren? Who train dem for us?’ ”


Dem go soon free pipol wey dey for prison; dem go get long life and honga nor go kill dem.


But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”


Jerusalem pipol, make una raiz and shine like sun, bikos God glory dey shine on-top una!


God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.


All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.


So Israel pipol, make una run komot from der! Make una run for una dear life and from my vexnashon.


God tell en pipol wey dey Babilon, “Una don eskape deat! So make una dey go and nor wait! Even doh una dey far from una land, make una tink about mi wey bi una Oga God and una go remember Jerusalem.”


So, make una run komot Babilon town! Make una run for una dear life! Make una nor die for nor-tin, bikos of Babilon pipol sin. I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.


Dia tree go bear fruits; dia fields go bear betta plant and evribody go stay for peace for en land. Wen I don break di shain wey dem take tie my pipol kon free dem from pipol wey dey trit dem like slave, den dem go know sey na mi bi God.


God tell en pipol, “Pipol wey dey nort, make una run, bikos I don skata una go evriwhere.


Zion pipol, make una eskape and run komot Babilon!


Dem go use swod kill some, karry some as prisona go anoda kountry and di Gentile pipol go distroy Jerusalem, until di time wey God sey Israel must sofa, go end.


“God Spirit dey my body, bikos E don anoint mi make I prish Good News give poor pipol. E send mi make I prish freedom give pipol wey dey prison and make blind pipol for si. E still sey make I free doz wey dem dey opress


Den I hear anoda vois from heaven sey, “My pipol, make una kom out from am, so dat una nor go follow am kommit sin kon sofa di same ponishment.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ