Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 52:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 But naw, many nashons go happy for am and kings nor go fit tok anytin. Dem go si and undastand di tins wey dem neva hear before.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 52:15
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di way yu dey si mi naw dey sopraiz yu! Make yu shok put yor hand for mout.


“True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.


Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”


God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”


I go kom save dem kwik-kwik, bikos my time to win, don near. Mi mysef go rule all di nashons. Di lands wey dey far dey wait make I kom; dem dey wait with hope make I kon save dem.


Naw, una go gada oda nashons wey una nor know before. And nashons wey nor know una before, go run kom meet una! Bikos mi wey bi di Oga una God, di Pesin wey bi Israel God wey dey holy, go make all dis tins happen. I go give una honor and glory.”


I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.


So, make evribody kwayet for God present, bikos E dey kom from en holy place.


Den e go bring hyssop leaf, deep am for wota kon sprinkol am for di tent, evritin for inside; for di pipol wey dey der and for di pesin wey tosh dead body, pesin bone or grave.


Dis na how yu go take make dem holy: Sprinkol di holy wota for dia body, den tell dem sey make dem shave di hair for dia whole body kon wosh dia klot, so dat dem go dey holy.


So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name,


Bikos God don promote am make e dey en rite hand and e don receive di Holy Spirit wey en Papa promise and naw, e don pour di Holy Spirit for awa body, as una si am dey happen so.


So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.


Na faith make Moses do di Passova and pour blood for pipol door-mot, so dat God angel wey dey kill all di first-born for Egypt, nor go tosh dem.


Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.


make dem dey holy thru en Spirit. Make una dey obey Christ for evritin and en blood go klean una. Make grace and peace bi una own!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ