God wey get pawa go distroy and swallow deat forever! Doz wey dey kry, God go klean dia eyes and E go remove di disgrace wey en pipol don sofa for dis world. God, wey dey lead heaven sojas, don tok.
e kon sey, “Make una tell di king: ‘Dis na wetin God tok: “Make una nor fear bikos of all di tins wey una hear and di curse wey Assyria king savant curse mi.
God sey, “Una wey wont make dem save una; una wey dey kom meet mi make I help una. Make una tink of di Rock wey una from kom, di place where dem from kut una from.
Make una nor fear, dem nor go disgrace una again. Make una nor fear at-all, bikos una nor go face shame again. Una go forget una shame wey happen wen una dey small and una nor go remember di sofa wey una sofa wen una nor get shidren.
But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well.
E klear sey na Christ rite dis leta by ensef kon send am thru us. Nor bi biro dem take rite am, but na di God wey dey alive Spirit dem take rite am, nor bi for paper, but na for awa heart.
Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,