Just as una swallow my pipol for my holy mountin, na so too una and di oda nashons go swallow di ponishment wey I go give una. Una go drink kon stagga until una disappear komot from dis eart.
Den my enemies go si sey God dey for my side and shame go katch dem. Dis na di same enemies wey ask sey, “Where dat yor Oga God dey?” And naw, I go si as dem dey fall and I go mash dem pass like portor-portor for road.
“I go make Jerusalem bi like cup wey wine full and all di kountries near am go drink from am kon dey stagga like drunkard man. And wen dem won attack Jerusalem, dem go attack all di town for Judah too.
Wen dem bring di kings kom meet Joshua, e koll Israel men kon tell di sojas oga wey dey with am sey, “Make una kom here kon mash dis kings for dia neck.” So dem kom put dia legs for di kings neck.