Make una kontinue to dey fool unasef! Make una dey bihave like pesin wey nor dey si! Make una dey stagga fall even wen una nor drink wine. Yes! Make una dey stagga waka, even doh una nor drink!
Jerusalem, make una wake-up! Make una karry unasef up! Una don drink from di ponishment cup wey God give una, bikos E dey vex. Una drink am and e dey make una stagga.
God sey, “My Jerusalem; di town wey dey sofa and nor get help; di place wey nor get who go konfort am. I go use stones wey dear well-well take build una foundashon again.