Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 51:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 51:13
56 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Zeresh en wife and en friends kon sey, “Go make one pole where dem dey hang pesin put and make e high rish seventy-five fit. Tumoro morning, make yu tell di king sey make dem hang Mordekai for der, den belle go sweet yu go di party.” Haman like wetin dem tok, so e kon make di pole.


So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.


yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong like iron wey dem polish?


Na only en make di heavens kon waka on-top wave for sea.


Yor dress dey shine like lite and Yu stresh di sky like curtain for heaven;


But si as dem kwik forget wetin God do! Dem nor gri listin to en advise!


True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.


Oga God wey get pawa tell en pipol for Zion, “Make una nor fear Assyria pipol; even doh dem dey opress una as Egypt pipol bin do una.


dem go laf Babilon king kon sey, “Make una si as evritin take end for di king wey dey opress pipol! E nor go ever fit opress anybody again!


Abeg! Make una allow us stay with una, so dat una go protet us from awa enemies! Wen doz wey opress us don die and distroshon nor dey again and awa enemies don disappear,


Israel pipol don forget di God wey save and protet dem like big rock. And naw, dem plant betta flowers and vines kon dey woship dem.


Una nor know? Dem neva tell una since? Una neva hear how di world take start?


Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.


God wey kreate heaven kon stresh am out, wey make di eart and evribody wey dey inside, di Pesin wey give life to di pipol wey dey di eart and spirit to doz wey dey waka inside sey,


Naw, God wey kreate una sey, “Make una nor fear, I go save una. I don koll una by una name and una bi my pipol!


Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.


Na mi bi di Pesin wey kreate di eart and na mi kreate di pipol wey dey stay inside. Na my pawa I take stresh di heavens out kon kontrol di sun, moon and di stars.


God wey kreate di heavens and di eart sey, na-im still bi God! Na mi kreate di eart well and I nor kreate am to dey empty, but na for pipol to stay. E sey, “Na mi bi God and e nor get anoda one.


Na my own hand I take make di eart foundashon kon spread di heavens with my rite hand and wen I koll dem, all of dem dey stand kom togeda.


I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”


Na raitiousness go make una strong. Una go dey save from pipol wey dey opress una and from doz wey dey kause wahala.


God sey, “Who bi all dis gods wey make una dey fear and lie for mi? Wey make una forget mi like dis? Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?


Den tell am make e nor worry or fear and make e nor let anybody disturb am, bikos King Rezin, en pipol and Pekah vexnashon nor get pawa rish di smoke wey dey kom out from two firewood.


All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.


Yong woman dey forget to wear en gold ring? Abi woman wey won marry, dey forget to wear en marriage klot? But e don tey wey my pipol don forget mi.


But di king ansa, “I dey fear awa own pipol wey don already surenda to Babilon king. Babilon king fit give mi to dem and dem go sofa mi.”


Dem dey fear wetin Babilon pipol go do wen dem hear sey Ishmael kill Gedalaya, di govnor wey Babilon king choose. As dem dey go, dem kon stop for Kimham wey dey near Betlehem.


God make di eart with en pawa; na en wisdom E take kreate di world kon spread di heavens with en sense.


Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. Na God wey get pawa, bi en name.


So naw, if una don ready, wons una hear di trumpet, di horn, lyre, jita, harp and all di oda instrument sound, make una bow woship di image. If una nor gri, na wons I go trow una enter di fire. Abi una tink sey any god dey wey go save una?”


But even if E nor save us, wi wont make yu know sey, wi nor go serve or woship yor gold image.”


King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.


At wons God angel kon nak Herod fall for groun, bikos e nor give God glory and plenty worm kon chop en body till e die.


Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?


“Yu deat! Where yor pawa? Yu deat! How yu go take shaut sey yu win?”


Dem don forget di Rock wey bi dia papa and di God wey kreate dem, nor dey dia mind again.


so make una dey kareful, so dat una nor go forget God wey take una komot Egypt.


Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today.


Infact, if to sey dem dey tink of di kountry where dem from kom, dem for get mind to go back.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


Dem go waka round di world and where God pipol dey stay and di town wey evribody love, fire go kom down from heaven kon burn am finish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ