So Oga God wey diliver Abraham, dis na wetin E dey tell Jakob shidren-shidren: “My pipol, dem nor go disgrace una again and una nor go dey shame again.
God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
God tell en pipol sey, “Wen di time don rish to save una, I go favor and ansa una wen una kry for help. I go guide and protet una kon make kovenant with evribody thru una. Una land wey skata and wey dirty bin full, I go klean am kon make una stay der again.
Make una nor fear, dem nor go disgrace una again. Make una nor fear at-all, bikos una nor go face shame again. Una go forget una shame wey happen wen una dey small and una nor go remember di sofa wey una sofa wen una nor get shidren.
Mi, God don promise to make yu strong like town wey dem dey guide well, wey nobody fit skata and like pila wey dem use iron take make or wall wey get bronze. Yu go fit stand against di whole land: dat is, Judah king, en ofisas, priest and all di pipol for di land.
Make pipol for evriwhere listin! Make evribody wey dey for dis world, listin to wetin I dey tok. God wey get pawa dey tok against una and E dey kom judge una from en holy temple.
“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”