3 I fit kover di sky with darkness kon make am wear sak like who dey mourn.”
Den God tell Moses, “Make yu stresh yor hand go heaven, so dat darkness go kover Egypt and dem go feel am, bikos e go tick well-well.”
True-true, all di stars and oda tins wey dey shine, go stop to shine. Di sun go dark as soon as e won kom out and di moon nor go give any lite again.
Wen dem look groun, dem nor go si anytin escept trobol and darkness wey go make dem fear well-well and e nor go get how dem go take eskape.
Bikos of dis, di eart go kry and di sky go black, bikos God don tok sey na so e go bi and E nor go shange en mind.”
E kon happen sey, from twelf go rish three oklok for aftanoon, darkness kon kover di whole land.
Den di Lamb open di sixt key and big eartkweke kon happen. Di sun kon dark like black klot and di moon kon dey red like blood.