Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 50:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 All of una wey dey plan to distroy oda pipol, na una own plan go distroy una. God ensef go make dis tins happen and una go sofa well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 50:11
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pipol wey dey run follow oda gods, dia trobol dey plenty evriday. I nor go follow dem do dia blood sakrifice or even koll dia god name.


Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.


Just as e bad for mad pesin to play with bow and arrow,


Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.


Wen dem look groun, dem nor go si anytin escept trobol and darkness wey go make dem fear well-well and e nor go get how dem go take eskape.


Di pipol wikedness dey burn like fire wey dey distroy both grass and shuku-shuku. E dey burn forest and en smoke dey go up to heaven.


Una go komot for di land wey I give una and I go make una serve una enemies for di land wey una nor know, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”


God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju.


“I send diziz kom meet una like di one wey happen to Egypt pipol. I kill una yong men for war kon skata una horse. I allow dead body dey smell for una kamps, but una nor still gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.


“I send hot breeze kon dry all wetin una plant. Ant chop all wetin una plant for una vineyard, even una fig and olive tree too. Yet una nor still gri turn kom meet mi.” Na Oga God dey tok so.


Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.


But make una dey sure about dis! Oga God wey dey kommand heaven sojas don tok: Evritin wey di nashons dey do nor mean anytin; all dia work go dey yuzles.


“Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’


But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”


Na dis make mi sey una go die inside una sin. Unless una bilive sey, ‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’, una go die inside una sin.”


Jesus tell am, “I kon judge pipol for di world, so dat di pipol wey nor dey si, go bigin si and doz wey tink sey dem dey si, dia eye go blind.”


as e bi sey dem nor know how God dey take make pipol good, instead, dem dey try to make demsef good by dia own pawa, since dem nor gri do wetin God wont.


Di tongue na fire! Na der bad tins full pass for pesin body. E dey spoil di whole body and kause fire for pesin life and dis kind fire dey kom from hell.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ