Judah my pikin, yu bi yong lion wey just chop wetin e kill finish. Yu dey kill like lion kon kwayet dey look; yu bi like woman lion, na who go fit fight am?
True-true, dis na wetin God tell mi, “Like lion wey dey shaut with vexnashon or yong lion wey won chop wetin e kill, na so I go bi like. Even doh many shepad gada round di lion, e nor dey fear dia shaut or run from dem. Na like dis too, Oga God wey dey lead heaven sojas, go kom help Mount Zion.
But naw, dem don tif all en pipol tins; lock dem undagroun kon hide dem for prison. Dem tif from dem kon karry all dia tins komot and nobody dey to save dem.
Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”
“Like lion wey run kom from Jordan bush kon katch sheep for fine betta land, na so too I go make Edom pipol run komot from dia kountry. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos e nor get anybody wey bi like mi and nobody fit shalenge mi! Wish ruler fit go against wetin I tok?
God sey, “Israel pipol bi like sheep wey run skata for evriwhere bikos lion dey porshu dem. Assyria king first attack and kill dem, before King Nebukadnezzar for Babilon kon break dia bones.
Doz wey remain for Israel go skata go oda nashons and dem go bi like lion among animals for bush; like yong lion wey dey mash and kill oda animals without who go save dem.
So wetin don happen to Nineveh, dat great town? Dat place where lion full? Just as lion and en shidren nor dey fear to waka, na so too di pipol for der nor dey fear to waka before.
Make una si as doz wey dey lead di pipol dey kry, bikos dia glory don vanish! Make una listin as lions dey shaut, bikos dem don distroy di bush where dem dey stay, near Jordan River!
Di nashon bi like strong lion; wen e dey sleep, nobody fit wake am. Anybody wey bless Israel pipol, go dey bless and anybody wey curse Israel pipol, curse go follow am.’ ”