28 Dem sharp dia arrow well and dia bows don ready to shot. Dia horse dey make nois like stone wey dem nak togeda and dia shariot taya dey turn like strong breeze.
Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”
“Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.
God sey, “Jerusalem! Make yu raiz-up kon skata di nashons, bikos I go give yu iron and bronze horn, so dat yu go fit distroy many nashons! Yu go give di propaty and di money wey dem tif to Oga God wey dey rule di eart.”