Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 5:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Una own don finish! Una wey dey sey bad tins, good and good tins, bad or sey darkness na lite and lite na darkness. Una dey sey bitter tins sweet and sweet tins bitter.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 5:20
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But my friends don turn nite to day; dem sey lite don near, but na darkness I dey si.


“Make una nor akuiz pesin for wetin e nor do and make una nor kill good pesin, bikos I nor go free anybody wey do like dat.


God nor like pipol wey dey defend wiked pipol and kondemn doz wey dey innocent.


Wikedness and wahala bi like food and drink to dem.


Dem nor dey sing or drink wine again, bikos nobody dey enjoy di taste bikos e dey bitter naw.


God go distroy doz wey dey lie against dia neighbours; pipol wey dey katch and kill pipol and doz wey nor dey give korrect judgement.


Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.


Nobody go sey foolish pipol get sense and doz wey dey deceive odas, nobody go sey dem wise.


Una disobey mi for my pipol front, so dat una go get small rice and bread to chop. Una kill pipol wey una nor suppose kill and pipol wey una suppose kill, una nor kill dem. So una dey lie give my pipol and dem dey bilive una.’ ”


Israel pipol dey turn bitter judgement to bad one, dem dey trowey wetin dey good and korrect for groun!


but na una even hate good tins kon love wiked tins. Una dey kill my pipol alive kon kut dia flesh from dia bone.


Bikos of dis, di law dey weak and yuzles and doz wey dey judge, nor dey judge well at-all. Wiked men dey opress good pipol; dem don turn betta judgement up-side-down.


Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”


Naw, wi dey sey, na pipol wey dey karry body up, happy pass. Wiked pipol nor dey only prosper, but dem dey test as God patient bi with di wiked tins wey dem dey do; yet nor-tin dey happen to dem.”


But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.


If two pipol kworel kon go kourt and di judge sey one dey rite and di oda one dey wrong.


As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ